POST A JOKE

Saturday 24 May 2014

Tagged Under:

FUNNY JOKE: Things That Happens Only in Nigeria

By: Akpors Comedy On: 2:23 am
  • Share Post
  • Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card.
    Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship.
    Then Airtel go com follow sey, recharge #100 and win benin republic.
    Glo, go just kuku say... Recharge 500 and win Nigeria bcos their colour na Green.

    Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"

    Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.

    Na only for Nigeria PHCN dey say: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (what a pity)

    Na only fo Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green.

    Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer.

    Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in the world...

    Like and comment if you love Naija!

    I LOVE NAIJA!


    1 comments: